Make you dey sure say you know am well well and you dey prepared bifo you go do abortion with tablets.
How long your belle don dey? Research talk say belle wey dem take medicine commot na im dem dey recommed most times for belle wey neva reach 13 weeks since you last see your period. Use pregnancy calculator take know how long your belle don dey since your last period.
If your last period start on or after:
You fit still use abortion medicine.
If you get intrauterine contraceptive device inside your uterus (e.g. IUD coil or progesterone IUD) you gas commot am. You must commot your IUD before you take your abortion medicine.
If you get HIV, make sure say your case no dey worse, you dey take antiretroviral medicine and your health dey make sense.
If you dey worri about how you wan take keep your abortion secret, make you put di abortion tablet unda di tongue instead of vagina. E go hard o, but if gbege happen and you need to see your healthcare people sharp sharp, dem fit still see de medicine for your toto. For some country, dem fit report you if dem see de medicine for inside your toto.
If you dey give pikin breast suck, Misoprostol fit dey make your pikin shit anyhow. To no let am happen, give your pikin breast suck, take de medicine, wait four hours before you give your pikin breast suck again.
If you get anemia (make iron low inside person blood), you need find healthcare person wey im place dey like 30 minutes from you so dat you go fit help you wen you need am. If you dey anemic, go meet doctor first before you take de abortion medicine.
No eat too much (e.g crackers, toast fit help you no feel like you wan vomit).
To get person wey go dey with you and take care of you make sense well well.
Drink plenti water throughout de whole process.
You fit take ibuprofen before you use Misoprostol to help reduce dey belle pain wey you go dey feel.
Wen you use de Misoprostol medicine, dey your area (like your house) where you fit get privacy and you fit lie down if you want, for some time after you don use de medicine.
Get back up plan before you take de abortion medicine in case you need emergency medical care.
American Congress of Obstetricians and Gynecologists talk say de first trimester medical abortion na im be one of de safest medical procedures. But make you dey always prepare incase any gbege happen and you need medical care sharp sharp. Reason our question wey dey down to help you get back up safety plan in case you need am.
You need fit reach de place inside 1 hour or less. (if you get anemia, you need reach there inside 30 minutes.)
Shey person dey wey go drive you? Shey you go take taxi? Public transport? How much be de money and shey dem dey available 24 hours? Remember say, e no safe to drive yourself go hospital wen you get emergency.
Dis website fit need cookies wey you no go know di name and so many third party service dem to make am work well. You fit read our Terms and Conditions and Privacy Rules . As you dey continue to dey use dis site you dey gree make we do dis.